Local

Ogun Police Burst Suspected Cult Doings

todayJune 18, 2026 5

Background
share close

Ogun State Police don burst one suspected cult initiation for Isara-Remo and carry away 30 young men.

According to reports, di suspects gather for one uncompleted building, dey drink alcohol, dey do initiation rites before police burst di place and scatter di whole show.

Police tuk tuk pesin, DSP Oluseyi Babaseyi, konfamate di operation on Thursday, say officers from di Violent Crime Response Unit (VCRU), together with Isara Area Command and Isara Division, carry out di operation on Tuesday and arrest all di suspects.

Police recover four abandoned vehicles, one jack knife, one local drum, one sekere, and several bottles wey dem believe say di suspects use drink alcohol during di gathering.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds