By: Esther Ayoola
Ogun State Police don call for better safety for all recreational centres and swimming pools across di state after 17-year-old boy drown die.
Police Public Relations Officer, Babseyi Oluseyi, tuk dis one on im X page on Wednesday, say di warning dey follow recurring drowning incidents for Ogun.
Di police spokesman explain say di teenager lose im life during one recent swimming-related accident, wey happen inside di state.
Oluseyi warn di public make dem dey careful and put proper safety measures for di centres to prevent more wahala like dis.