By: Ayobami Dada
Arthur Okonkwo don receive Naija call-up for di AFCON qualifiers against Madagascar and Guinea-Bissau.
Di 24-year-old goalkeeper wey dey on loan at Charlton from Wrexham go compete with Stanley Nwabali and Maduka Okoye for starting spot.
Naija go host Madagascar for Uyo on September 25 before dem travel go face Guinea-Bissau four days later.