By: Esther Ayoola
Galatasaray striker Victor Osimhen don clear air, say all di tuks wey dey go round about im future, nor dey anywia.
Dis one come afta Super Eagles coach Eric Chelle tuk say Osimhen fit miss Naija friendly games against Poland and Portugal because of possible transfer mata.
But Chelle bin try tuk say di striker just need relax afta long season according to di Super Eagles media team.
Osimhen on im Instagram handle sti insist say people misquote di mata and say im fully dey focus on football.