Lagos

Otti Hail Abia Biker We Ride From Lagos, Vow To Still Put People First

todayOctober 28, 2025 1

Background
share close

Governor Alex Otti don talk say him government no go gree make anything distract dem from giving Abia people di real dividends of democracy, as him still stand gidigba to better di welfare and well-being of di people. Di Governor yarn dis one when him receive one Abia-born cyclist, Mr. Wisdom Chisom, we ride bicycle all di way from Lagos reach Abia just to honour di Governor for him visible and impactful work wey don change di face of di state within short time. Otti talk say di happiness wey di people dey show na proof say di government dey deliver well, and he promise say nothing go stop dem from doing more.

Mr. Wisdom, we come from Nunya for Isiukwuato Local Government Area, talk say when him visit him village recently, he shock see how di 11.5km Nunya–Eluama Road don change under Otti’s government. Him talk say even for Umuahia Tower, everywhere don get light and traffic light full ground. Out of excitement, he decide to ride bicycle from Lagos to Abia to honour di Governor, calling di bicycle a “symbol of honour.” Di cyclist come even talk say police for road dey hail Otti as “good man” when dem see am. Otti thank am well-well for di love and tell am make he continue to be good ambassador for Abia State anywhere he go.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app