By: Esther Ayoola
Unto matters for Lekki area, say one unkown driver go jam five pikins with im koropke, kabu kabu motor for Lekki, Lagos, afta im motor lose control.
According to report, say di driver bin dey drive wawa speed, jam di innocent children wey dey dia own, Igboa.
From statement wey fall out from di area Controller General of di Lagos State Fire and Rescue Service, Margaret Adeseye, di accident happen about 2:31pm for Wole Olateju Crescent, Lekki Phase One.
Adeseye say, di Four pikin between eight and thirteen years get serious injury and dem don carry dem go hospital, while one nine-year-old boy kpai on di spot.