Lagos

Owu-Ikosi Kingdom Beg Gov Sanwo-Olu Make E Help Pursue Land Grabbers

todayOctober 8, 2025 5

Background
share close

Owu-Ikosi Kingdom for Ikosi-Ejirin LCDA inside Epe Division of Lagos, don raise alarm over how ajagungbale (land grabbers) don take over their land, chase residents, and scatter local business. For press conference wey happen for the palace of the Olowu of Owu-Ikosi, Oba Nelson Aderemi Ogunlari, the monarch say the crisis don dey serious and if Lagos State government no act fast, e fit turn full-blown chaos like herdsmen palava for other parts of Nigeria. “Dem don enter many villages, including our own. We chase dem before, but dem don return again, this time with more aggression,” the king talk. Oba Ogunlari, wey sit with him chiefs, say the kingdom no support or follow anybody wey dey grab land, and say the royal stool don dissociate from all illegal land sales or violence. The king beg Governor Babajide Sanwo-Olu, the Lagos State House of Assembly, and all security agencies, including the police, DSS, and Area N Commander,, to come quickly rescue the community before matter spoil. “Make dem no wait until lives start to dey lost. This thing don dey affect farming, trade, and even government projects like the relocation of sawmillers to Imofa,” he warn.

Chief Olumide Osilaja, Oluwo/Jagun Oba of Owu-Ikosi, give full picture of how life don turn hard for residents. “Dem landgrabbers dey our farms now, armed with cutlass and guns. Dem dey harass our people, extort buyers from sawmill, and dey take hard drugs openly. Our women no fit sell market again,” he talk. Prince Adeoluwa Adekoya, Baale of Asaasa/Oke-Odo, say residents now dey hear gunshots for their area. “The fear don too much. We dey beg the governor and security forces to act fast before this thing pass government power,” he add. The kingdom also beg Lagos State House of Assembly to pass a stronger law to support the work of the Lagos Task Force on Land Grabbers, so that this kain thing no go continue for other communities.

 

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app