By : Jolayemi Olajide
Meanwhile, Angry families of dipupils and teachers wey bandits kidnap for Orire local government area for Oyo State don reject rice and money wey oyo state gorment bin give dem to cool dia temper.
Di Baale of Yawota, Emmanuel Alade, clear news tatafo on Monday, how dem feel, say di parents pursue baba govo, Seyi Makinde team comot because food no be dia problem now.
Di people reject di relief materials during di condolence visit because dem insist say di only thing dem want na make dia family members return alive.
This heavy gbege happen after bandits storm di Oyo village carry school pickin and teachers waka, wey con make di parents vex refuse di government money.