Senegal midfielder, Pape Gueye, don announce say e no go play for Senegal national team again as long as head coach, Pape Thiaw, still dey in charge.
Di 27-year-old make di announcement for social media after Senegal blow two-goal lead come lose 3-2 to Belgium after extra time for dia 2026 FIFA World Cup Round of 16 match.
For di post wey e write for French, Gueye tok say e go later tok about how Senegal take crash out of di tournament, but e make am clear say e no go play under di current coaching crew.