OBODO NAIJA

Peter Obi Talk Say E No Need 100 Years To Fix Nigeria

todaySeptember 10, 2026 5

Background
share close

NDC presidential candidate, Peter Obi, don talk say e no need 100 years to put Nigeria back on di right track, as e insist say di country dey go wrong direction now.

Obi, wey promise say e go spend only one term as Nigeria Presido, talk dis on Thursday during interview with one tuk tuk station, saying e no desperate to become presido.

E say once e enter office, e no go stay one day pass di period wey e promise, because Nigeria no need plenty years before e fit start moving for di right direction.

Obi say di main thing na to reverse di country current direction and put Nigeria back on di right path, adding say na wetin e dey focused on.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds