OBODO NAIJA

Peter Obi Tell Tinubu To Come Out, Talk Directly To Nigerians

todayJuly 27, 2026 4

Background
share close

By: Esther Daniel

2027 presidential candidate of di Nigeria Democratic Congress (NDC), Peter Obi, don call on Presido Bola Tinubu to speak directly to Nigerians instead of leaving government aides and spokesmen to explain government policies.

Obi yarn dis one for siddun tok on sunday say Nigerians vote for Tinubu and want hear from am, adding say di Presido don turn Aso Rock into “bunker” and no longer dey communicate with di people.

Di former Anambra State governor also question di way di Presidency handle important national issues, including di controversy surrounding di Presidential Economic Advisory Council and Presidential Foreign Intervention Promotion Council.

Obi promise say if e become Presido, e go make agriculture one of im top priorities, saying Nigeria get enough land to produce food, create jobs and earn more money from farming.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds