Warri pipo dey jolificate as di FIFA Presido, Gianni Infantino, land for Delta State, today Friday, November 20, 2026, Na di Delta Govo, Sheriff Oborevwori, welcome am ahead of tomorrow opening of Warri City Stadium and Hussey College pitch Di FIFA presido tok say body sweet am as e come.
E stii clap hand for Warri grassroots football and troway salute give Nigeria Flamingos for dia Under-17 Women’s World Cup victory.
Infantino go di join CAF Presido, Patrice Motsepe, and football leaders from 54 African countries for di 48th CAF Ordinary General Assembly wey dey happen for Abuja tomorrow.
Na di first time Nigeria dey host di meeting in 17 years, while Lagos go host CAF Awards on December 2.