OBODO NAIJA

Peter Obi Want Make Dem Touchlight Enugu Air Runway Askident

todayJuly 24, 2026 4

Background
share close

Peter Obi don show joy after Enugu Air plane run comot from runway as e dey land for Benin Airport, and e thank God say all 68 passengers and crew members come out safe without any injury or death.

For statement wey e post for X on Friday, Obi praise di pilot, cabin crew and airport emergency workers for dia fast and professional work wey hellep stop bigger gbege.

E tok say di safe landing na something to thank God for, however Nigeria aviation still need better safety.

Obi still call for better touchlighting to find out wetin really cause di askident.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds