Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Lagos State Police Command don arrest one private security guard wey dem dey call Amos Kini, say e allegedly carry one two-year-old pikin comot and dey ask di pikin family make dem pay ₦5 million ransom. Police tok-tok person, Abimbola Adebisi, yarn dis one for statement wey e drop on Monday. E talk say di gbege happen for night of Saturday, September 21, 2025, for Elemoro area of Lagos. According to Adebisi, na di pikin mama run go report for Elemoro Divisional Headquarters say Kini don disappear with her pikin and her phone around 11:50 p.m. Sharp sharp after that, di suspect use di stolen phone take call di pikin papa come dey demand ransom before dem go free di boy. As dem receive di report, operatives from Elemoro Division quickly swing into action. Dem sharply go di scene, do proper check and document wetin happen.
One Aruna Dauda, wey stand as guarantor for the suspect before dem give am di security work, na im police carry go for questioning, na wetin Adebisi talk. She still add say na correct intelligence gathering and heavy surveillance make di suspect release di pikin without touch am. But police no gree rest as dem continue dia manhunt, and on September 23, officers from di Tactical Squad wey dem dey call Hyena track Kini go him hideout for Elemoro, na there dem nack am arrest. Police talk say Kini don confess say na true e do di thing, and e still dey for dia custody. Dem go carry am go court once dem finish dia investigation. Lagos State Commissioner of Police, CP Olohundare Jimoh, condemn di abduction and yan say di command dey serious to fight violent and big big crime dem. E come urge parents and guardians make dem dey watch well well, and encourage everybody to report any suspicious gbege by calling di command emergency numbers: 08063299264, 09053872208, and 08087332678.
Written by: News Editor 1
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025