Lagos

Police Gbab Suspected Armed Robber for Lagos

todayJuly 30, 2026 13

Background
share close

Lagos State Police Command don arrest one 29-year-old man wey dem suspect say na armed robber during routine patrol on Wednesday for Igando area of Lagos.

Police tuk, tuk person, SP Abimbola Adebisi, naim konfamate dis one say officers sight three men wey dey ride one motorcycle and dey behave funny and na so dem take follow dem up.

She say as di suspects see police, dem try run, but officers catch one of dem while di remaining two escape and abandon di motorcycle.

Police recover one locally-made pistol and different charms from di suspect, while investigation dey continue to track down di two wey escape.

 

Read similar tori for here:https://konfamfm.com/lagos-police-gbab-118-suspects-bust-kidnappers-cultists-and-vandals-for-april-crackdown/

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds