By: Esther Ayoola
Lagos state police command don carry fork, wrake and all dia equipment enter Lagos dey find one driver wey dem accuse of killing a house agent, Yinka Agboola, because of fight over parking space for, orchid road, Lekki.
U sabi say, Konfam bin report last week how di wahala take start, dem tell di driver make e move im motor from middle of road and even show am another place to park, but man wey get cocoanut head nor gree for anybody.
Aproko pipo wey dey ground say, na so di man vex enter im car, drive anyhow, while Agboola try stop am, e bgoai, na so e jam di wetin nor good for wall and na man wey dem jam stolz enter heaven, nor argue sef.
However, according to the ogbonge update from police tuk tuk persin, Abimbola Adebisi, say Agboola don die confamato, and so dem ma wey be police dey find who kill persin and dat dem don succeed seize di motor wey dem use kill persin.