By: Esther Ayoola
Say Security tie wrappa for Kano State Gornment House dat, oga govo, Abba Yusuf dey make move to defect go other party.
Na so security mehn block di gate, combined security force from di Nigeria Police Force and di Department of State Services (DSS) all of dem joinbodi for di location.
According to report, if u must enter di gorment house, u must identify yaself, show ID card.
Dis one sef dey follow speculation about a disagreement between Governor Yusuf and im political mentor, Senator Rabiu Musa Kwankwaso.