Kano State Police Command don rescue one two-year-old boy wey jaguda boys carry, dem still grab three suspects and recover ₦930,000 from di ransom wey family pay.
Police tuk dis one for statement wey dem drop on Saturday, wey Police PRO Abdullahi Kiyawa sign, as e break down how di pikin take miss and how police track di matter use correct informate go bring am back.
Kiyawa talk say di tori start April 19, when one man for Gwammaja Quarters, Dala LGA, raise alarm say dem carry im two-year-old son, Aliyu Muhammad, right for front of dia house.