Edited by Ebi Oboko
Nigerian Power Slap heavyweight, Kabiru Adediran wey people sabi as “Hulk”, don challenge British-Nigerian boxing star Anthony Joshua to one fight.
Hulk tok say nor be cruise oh dat, im go like enter ring with Joshua wey e call im role model.
According to am, even if Joshua beat am, di fight fit change im life because e go still collect beta money.
Di former Davido bouncer still boast say im get strong hand and correct mindset to face any opponent.