Wi oga Presido, Bola Tinubu don scata mouth again oh, say e no dey fear any opposition, as e describe dem as pipo wey just dey make noise and wey nor understand law.
E yarn dis one during meeting with Renewed Hope Ambassadors leaders from all 36 states for State House, Abuja on Thursday.
Say Na oga of APC govos group, , Hope Uzodimma, wey be DG of the ambassadors, naim carry im members go meet baba Seyi, and im clear dem di need why dem must uphold dia integrity.