By: Esther Ayoola
U.S. Presido, Donald Trump say im go dey “indirectly” involve for di second round nuclear tuks wey go happen for Geneva between US and Iran.
Iran Foreign Minister Abbas Araghchi don already land Geneva for meeting before di tuks proper.
Tension for Gulf, still dey high, as US don send another aircraft carrier, and Iran for dia part through dia Supreme Leader Khamenei, say, any attack, go start regional war.
Trump dey insist say di tuks important, and say Iran sabi wetin dem U.S. fit do to dem, if dem nor behave demselves.