Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
President Emmanuel Macron of France tuk on Tuesday say France fit hellep protect ships for Strait of Hormuz, but only if di situation don cool down.
E tuk am for France, afta US Presido Donald Trump, beg im allies to help secure di waterway wey Iran don block because of di US and Israel attack.
Macron explain say oil price don jump 40–50% since Iran begin attack ships with missiles and drones for Gulf, and that France no go force any tin.
He sti press tuk, say France ready to work with other nations to escort ships later when e calm, showing how dem fit help without joining di war.
Written by: News Author
Donald Trump statement France naval escort Strait of Hormuz security
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026