By: Yusuf Abuh
Wi oga Presido Bola Tinubu don order Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission, wey dem dey call ICPC, say make dem touch light every as e take concernĀ Presidential Foreign Intervention Promotion Council (PFIPC) and di ogbonge agency wey don dey cause jogolo for weeks now.
Presido say make ICPC finish di investigation and submit full report give am within 30 days.
According to Special Adviser to di Presido on Information and Strategy, Bayo Onanuga, di order come after government discover say PFIPC na fake body wey Federal Gornment never create.
Gornment tuk say di council no get any legal backing, presidential approval or any lawful authority to operate.