Wi First Lady, Senator Oluremi Tinubu, don salutate all fathers of di land and around di world for dia sacrifices.
She put dis one for statement for Abuja, as di world dey mark fathers day, yesterday. Our mummy drop advice oh, Say make all mama and pikins, for di obodo Nigeria, make dem buy barbecue fish for our fathers, dat dose men dey try, as dem take dey chest plenty billings steady, steady.
She still hail father-figures (nor be di once wey dey carry ajoor money go play bet oh) real father figures and mentors wey dey impact pipo life and help build strong community.
Mummy Tinubu, turn prayer warrior for di mata na, say make God bless all fathers, based on say na dem be dia family backbone.