By: Rilwan Agbomeji
House of Reps Public Accounts Committee don claer marras dat make di nnpcl drop all di missing documents of company and show face for Abuja before December 15, 2025, over 2021 spending audit wahala.
Chairman Bamidele Salam vex for Monday sitting as e blast NNPCL for always dodging summons and refusing to bring di papers wey dem ask for.
E talk say di kain disrespect wey di company dey show Parliament dey block proper audit review and di committee no go gree again.
Afta NNPCL liaison officer beg, PAC give dem one last chance and warn say any extra delay go bring serious action wey go shake ground.
NNPCL still get questions to answer on payments wey dem make for abandoned projects, how dem no deduct statutory taxes, and some approvals wey dia finance office do wey no follow normal procedure.