By: Mariam Ajayi
Oga Govo Babajide Sanwo-Olu don arrange meeting with Lagos pensioners on Thursday, as e wan hear why dem dey vex.
Di pensioners don dey protest for Alausa, say government never pay dem dia entitlements for two years, after dem serve Lagos for 35 years.
Dem say dem don tire to wait, as dem dey demand make government pay wetin dem don work for.