Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Senate don approve oga Presido Bola Tinubu request to borrow $6 billion from outside.
Chairmo of di Senate Committee on Local and Foreign Debts, Senator Aliyu Wamakko, clear dis mata say, Tinubu write two separate letters to Senate Presido, Godswill Akpabio, asking $5 billion from Abu Dhabi Bank for budget deficit and old debts, and $1 billion from UK Export Finance through Citibank London to fix Lagos and Tin Can Island ports.
Di mata nor too waste time for di senate house on Tuesday, according to di senate presido, im dey impress with di committee work therefore give di approval
Written by: Ridwan Agbomeji
bola ahamed tinubu Godswill Akpabio Nigeria
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026