By: Esther Ayoola
Senate don call emergency plenary sitting for Tuesday as pipo dey vex for di way senate take dey handle fi Electoral Act (Amendment) Bill, especially reports on clause to comot real-time electronic transmission of election results.
Di announcement come from Clerk of di Senate, Emmanuel Odo, say, Senate Presido, Godswill Akpabio don order all senators make dem reconvene by 12 noon on Tuesday, February 10, 2026.
Dis move dey come as Nigeria Labour Congress raise alarm, warn say dem fit do nationwide protest, if Senate no clear dia stand on di electronic transmission mata.
NLC even tuk say election boycott dey possible because of di confusion and waka-come-waka-go position wey Senate dey show on di amendment.