Nna wa o, for inside Abuja, the Senate don nack Federal Gornment and security people strong Akpako for head say make dem sharply rescue the Oyo State school students and teachers Wey bad boys kidnap.
Na Senator Abdulfatai Buhari carry the mata tuk first say around 46 people dey inside the kidnappers net.
While Senator Adams Oshiomhole tuk about o how the military dey spend money Wey dem dey give dem to fight insecurity, other senators look am sideways and nobody support am.
Even with that one, some other lawmakers still challenge the Presido, say make im query the Service Chiefs untop dis insecurity mata