By: Esther Ayoola
Manchester united fine form don continue as Benjamin Sesko come off di bench helping im team beat Everton 1 kondo for Monday night Premier League football match.
Dis win sti keep Michael Carrick unbeaten, since e start to coach United.
Sesko neva start any of Carrick six games but e dey fire wetin nor good, since Ruben Amorim comot for Manchester for January.
Di Slovenian, wey score only two times for im first 22 games afta e $100 million move from RB Leipzig, don score six goals for him last seven games now.