Soldiers of Nigerian Army, with support from Air Force, don rescue di wife of late Major General Rabe Abubakar, Amina Abubakar, wey bandits carry go weeks ago.
According to Defence Headquarters, through di Director of Defence Information, Major General Samaila Uba, dem say di rescue hapun under Operation FASAN YAMMA.
Troops explain say dem jam di kidnappers for Tunga Village during serious search and attack operation against di criminals.
As soldiers dey advance, di bandits shoot di woman before dem abandon am and run comot.