obodo oyinbo

South Africa Presido Tell Immigrants, To Respect South Africa Laws, Traditions

todayApril 27, 2026 3

Background
share close

By: Esther Ayoola

South Africa Presido, Cyril Ramaphosa don tell Nigerians and other foreign nationals wey dey live for South Africa say make dem respect di country laws, culture and traditions.

Ramaphosa tuk dis one on Freedom Day during SABC News broadcast on Monday, as tension over anti-foreigner mata dey rise for some parts of di country.

E advise say anybody wey dey South Africa legally suppose follow di rules just like dem expect respect from other countries.

Di president add say gornment go sti uphold human rights and global joinbodi, but dem go also enforce immigration laws to control illegal stay and maintain order.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds