By: Esther Ayoola
Say wi Federal gorment bin approve 30% pay increase for non-academic staff for federal universities, polytechnics and colleges of education, but like dis, SSANU don reject di 30% increase.
Nor be amebo say di Minister of Education, Dr Tunji Alausa, put for one letter wey e write on March 30, 2026, say di raise go come as Consolidated Non-Teaching Tools Allowance to reduce salary wahala and settle long-standing agitation.
But SSANU NEC reject di offer, tuk say dem nor go agree anything and say dem dey vex because of salary check and balance wella and unpaid allowances for di tertiary schools.
SSANU do press conference on Sunday, warn say if gornment no finish negotiation before end of April, dem fit begin in strike nationwide.