obodo oyinbo

Bangladeshi Workers Protest For Road On Top Wages Wahala

todayNovember 18, 2026 8

Background
share close
Wahala burst inside Gazipur city, Savar, Ashulia (ah-shoo-LEE-uh), and Mirpur (meeuh-puh) area on di outskirts of Dhaka, Bangladesh, on Tuesday, November 17, 2026, as police shoot tear gas and sound grenade to scatter many many garment workers wey block di main Dhaka to Mymensingh (meye-muhn-sing) highway and burn motor because di gornment shift meeting about dia salary.
Di workers dey vex say dem want make gornment increase dia monthly money from 12,500 taka (Bangladesh currency) to 30,000 taka because food and house rent wan kpai dem, and dis fight don make about 500 factories close down.
Meanwhile, gornment don send extra police and dia  soldiers enter street with drones and body camera to watch di area, while di wage board press mouth say any new salary wey dem agree go start work from December 1.

Written by: Jolayemi Olajide

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds