By: Jolayemi Olajide
Federal Capital Territory Minister, Nyesom Wike, don promise Qatar gornment say FCT Administration go support dem to settle wahala over land wey dem allocate to Qatar embassy for Abuja.
Wike media aide, Lere Olayinka, reveal dis one for statement wey e release on Tuesday.
Wike give di assurance when e meet Qatar Ambassador to Naija, Yousef Ahmed Al-Hail, for Abuja, as dem discuss diplomatic relations, urban development, investment and ways both countries fit work together.
Di ambassador raise concern over court letter wey dey challenge Qatar ownership of di 8,000-square-metre land, and e ask FCT Administration to clear di matter make Qatar fit continue im development plans.