OBODO NAIJA

Retired Police Officers Mount Protest For Abuja.

todayNovember 18, 2026 8

Background
share close
Police wey don retire mount Federal Ministry of Finance inside Abuja yesterday, Tuesday, November 17, 2026, dey cry out say dem accept Presido Bola Tinubu gornment offer of 200 percent gratuity and 100 percent pension, but gornment never pay dem kobo.
Dia National Secretary, Assistant Superintendent of Police Elnathan Jared wey don retire, press mouth say dem go continue to sleep for dat protest ground until bank alert enter dia phone, as another retired ASP dey cry say suffer head don hold am tight, e nor fit even train him pikin dem or buy medicine for hospital.
Di angry old officers carry placard with diffrent write up for gate, dey beg Finance Minister Wale Edun and Inspector General of Police make dem open eye look dia matter sharp sharp before hunger kill pipo wey serve dis country with dia blood and sweat.

Written by: Jolayemi Olajide

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds