argentina

7 Results / Page 1 of 1

Background

Sports

Spain Beat Argentina 1-0 for World Cup Final

Spain don win di 2026 FIFA World Cup after dem beat defending champions Argentina 1- kondo for extra time in Sunday’s final. Na substitute Ferran Torres score di only goal of di match to give La Roja their second World Cup title, 16 years after dem first lift di trophy for South Africa in 2010. Argentina goalkeeper Emiliano Martínez make plenty important saves, but Enzo Fernández red card late for […]

todayJuly 20, 2026 15

Sports

FIFA Pick Vinčić to Officiate Spain vs Argentina Final Showdown

By: Esther Daniel Slovenian referee Slavko Vinčić go dey handle di big stage on Sunday as FIFA pick am to officiate di 2026 World Cup final between Spain and Argentina. Di 46-year-old go become di first Slovenian referee wey go take charge of a World Cup final and di 23rd official for history to get di honour. FIFA Chief Refereeing Officer, Pierluigi Collina, give Vinčić di news during an emotional […]

todayJuly 17, 2026 14

Sports

Argentina Fit Enter Wahala As Dia Players Carry Political Banner

Argentina fit colobi punishment from FIFA after some of dia players celebrate their World Cup semi-final win over England with one banner wey support their country's claim to di Falkland Islands. Argentina come from one goal down beat England 2-1 for Wednesday semi-final in Atlanta, wey carry dem enter Sunday World Cup final against Spain. After di final whistle, some Argentina players raise one banner wey write "Las Malvinas son […]

todayJuly 16, 2026 12

Sports

FIFA Pick Portuguese Officials For Argentina, Switzerland Match

By: Yusuf Abuh FIFA don do am again oh, dem go pick Portuguese match referees  go handle di FIFA World Cup 2026 quarter-final between Argentina and Switzerland. Di match go shelle on Saturday, July 11, for Kansas City Stadium. FIFA announce di appointment for one post wey dem share for X on Thursday. Joao Pinheiro go be di centre referee, while Bruno Jesus and Luciano Maia go serve as assistant […]

todayJuly 10, 2026 12

Sports

Cape Verde Ready For Messi And Argentina World Cup War

Today, Africa world cup new comers,  Cabo Verde don rake full newspaper say dem nor dey fear anything, say dem go follow up defending champions Argentina  for Miami as both teams battle for place in di World Cup last 16. Cabo Verde, wey be di smallest country to ever reach di knockout stage, don surprise many people after dem draw  Spain and qualify ahead of Uruguay and Saudi Arabia. Argentina, […]

todayJuly 3, 2026 15

Sport Yarns

Pochettino tell Messi Sorry, for im papa wey dey hospital

By : Jolayemi Olajide USMNT head coach, Mauricio Pochettino, don message Lionel Messi and im family, after dem rush Messi papa go hospital. Pochettino fry mouth say normal, messi papa, Jorge, receiving treatment for hospital na distraction, but encourage di senior man to stay focus dat im papa go dey alryt. Di former PSG boss, wey sabi Messi well-well, send im full support and best wishes to the family as […]

todayJune 19, 2026 12

Sports

Messi to Lead Argentina 26-Man Squad For World Cup

Argentina  coachie, Lionel Scaloni don release im  26 players wey im wan carry go di 2026 world cup say na Lionel Messi go lead dem. Di 38-year-old football king na im top di list, but one big surprise na say Real Madrid star boy Franco Mastantuono no dey among di players wey dey go di tournament. Dis major competition go make am di sixth time wey Messi dey play for […]

todayMay 29, 2026 29 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds