Jolayemi Olajide
Cristiano Ronaldo sister, Elma, don come out to cut chain give Portugal after her brother comot from di national team camp on Wednesday.
For post wey she make for Instagram, Elma say Portugal no deserve di best for anything.
She say CR7 deserve more respect, while di national team need better settings, and Portuguese tori pipo gas do better instead of spreading rumor.
Elma still blast Portuguese pipo, say dem too dey jealous , and dem dey disrespectful and ignorant.
Ronaldo don return to Madrid and e no go play di upcoming UEFA Nations League matches for Portugal against Denmark and Norway.