NLC Tell Gornment Say Make Dem Bring Fuel Price Down
Nigeria Labour Congress, NLC, don call on gornment to reduce petrol price, pay workers nationwide wage award and start fresh toks on new minimum wage, as Nigerians dey struggle to survive under high cost of living. For Independence Day statement wey dia Presido, Joe Ajaero, sign on Wednesday, di union tok say workers and ordinary Nigerians don dey suffer under high transport fare, food price, house rent and school fees. […]