OGUN STATE NEWS

6 Results / Page 1 of 1

Background

OBODO NAIJA

Ogun Customs Burst Smugglers, Seize Contraband Goods

By : Jolayemi Olajide Nigeria Customs Service for Ogun Area 1 branch yesterday do small jet li seize 10,126 parcels of Indian hemp wey pipo dey call Ghana Loud, and say di drugs fit reach over N6 billion. Acting Comptroller Olukayode Afeni naim dey konfamate dis mata say dem catch the contraband for different places across Ogun State as dem dey fight smugglers and illegal business. According to am, di […]

todayMay 13, 2026 7

south west

Ogun State Catch 45 Pipo Say Dem Park Dirty For Road

By: Esther Ayoola Ogun State Waste Management Authority officials don arrest and sentence not fewer than 45 residents to community service because say dem dump dirty anyhow for roadsides and public places. According to di Ogun state waste management pipo, di arrest hapun for Quarry Road and Kolobo area. Konfaming di report, Agency adviser, Farook Akintunde, say di action na to end yangayanga throwing of dirty for Ogun state and […]

todayMay 8, 2026 6

Lagos

Ogun Bike Snatching Turn Deadly As Rider Lose Life

By: Esther Ayoola Ogun State Police command don do Rambo doings arrest one 27-year-old man, Chidi Ebere, wey bin dey try snatch motorbike from rider and ending up kpaing di drive. According to di Police tuk, tuk, Babaseyi Oluseyi, statement, say di man first enter di bike like passenger for Igbesa area, before e attack di rider. During di struggle, di rider, Sunday Ogbu, try defend himself but di suspect […]

todayApril 10, 2026 11

National

Tinubu, Dapo Abiodun Mourn As Olabisi Onabanjo Wife Kpai

By: Esther Ayoola Oga Presido, Bola Tinubu and Ogun State Governor Dapo Abiodun don express sorrow over di death of Madam Lucia Onabanjo, wife of late Chief Olabisi Onabanjo, former civilian governor of Ogun State. Madam Lucia kpai on Monday, January 11, 2026, for age 100, as her daughter Olubukunola Onabanjo confirm am. Di family describe am as a loving mother, grandmother and great-grandmother wey live long life full of […]

todayJanuary 14, 2026 17

Entertainment

Ogun Go Drag DJ Chicken Court Over Multiple Road Crashes

Ogun State Ministry of Justice don announce say dem go prosecute TikTok content creator Ademola Abiodun, wey people sabi as DJ Chicken, following series of road accidents wey don raise concern about public safety. DJ Chicken allegedly crash into two motorcycles for Sagamu, Ogun State on November 1, 2025, wey critically injure one rider and female passenger. Government talk for official X handle say witnesses report say Abiodun try run […]

todayNovember 26, 2025 19

National

Insecurity – Abiodun Meet Security Chiefs To Protect Ogun

Ogun State Governor, Dapo Abiodun, on Monday hold meeting with di security chiefs for di state to check security level and boost preparedness. For im post on X, Abiodun talk say e meet di chiefs to assess di security situation for Ogun and Nigeria as e affect dem. E remind say “di best time to prepare for war na when peace dey,” as Ogun still dey rated among di most […]

todayNovember 24, 2025 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds