By: Esther Ayoola
Ogun State Waste Management Authority officials don arrest and sentence not fewer than 45 residents to community service because say dem dump dirty anyhow for roadsides and public places.
According to di Ogun state waste management pipo, di arrest hapun for Quarry Road and Kolobo area.
Konfaming di report, Agency adviser, Farook Akintunde, say di action na to end yangayanga throwing of dirty for Ogun state and dat e dey spoil environment, affect public health, and fit cause disease and water pollution.
E con also explain say, even afta many awareness campaigns on how to properly dispose waste, some residents sti no follow di rules, na why dem carry out di enforcement.