Gunmen Scatter PVC Sharing For Osun, Carry Voter Cards Go
By: Esther Daniel Some people wey dem suspect say na hoodlums storm one INEC PVC collection centre for Oyinlola DC School, Okuku, Osun State on Sunday and carry some packs of Permanent Voter Cards comot. Witnesses tok say di men enter di place quietly before dem begin shoot for air, make everybody run for safety. Di attack scatter di PVC sharing exercise as people wey come collect dia voter cards […]