PREMIER LEAGUE

19 Results / Page 2 of 3

Background

Sports

Former Arsenal Star, Gallas Name Di Cup Wey Arsenal Fit Win

Former Chelsea and Arsenal defender William Gallas tuk say di only trophy wey Arsenal fit win dis season na di Premier League. Dem bin dey try for quadruple, but dem lose Carabao Cup final to Manchester City. Now, Mikel Arteta side, dey fight for Premier League, FA Cup and Champions League. Gallas say e no believe say Arsenal fit win all three trophies dis season.

todayApril 3, 2026 14

Sports

No Write Note Giv Chelsea Players – Emmanuel Petit

France legend Emmanuel Petit don clear Chelsea manager Liam Rosenior to stop passing note to players. Petit tuk dis one during im chat with Talksport, after Chelsea lose 3-0 to Everton for Premier League. E tuk say Rosenior dey shame imself with di paper, because players no be children, dem no need all dis kind writing. Petit explain say whenever Rosenior try show substitution note to players wey dey come […]

todayMarch 24, 2026 13

Sports

Amorim Vex Say Man Utd Just Dey Waste Chances

By: Rilwan Agbomeji Manchester United boss Ruben Amorim don para after im players waste plenty chances as dem throway 1-0 lead take draw 1-1 with struggling West Ham for Premier League on Thursday. Amorim, wey dey fight to drag United comot from 8th position, blame im boys say dem no get killer instinct as dem don repeat di same wahala against Tottenham, Nottingham Forest, and even lose 1-0 to 10-man […]

todayDecember 5, 2025 12

Sports

Rooney Blame Salah For Liverpool Slump

Former Manchester United striker Wayne Rooney don blast Mohamed Salah for Liverpool slump, as e tell Reds coach Arne Slot make e even reason drop di Egyptian from di starting lineup. Sky Sport report on Monday say Rooney dey refer to Liverpool 3–0 home loss to Nottingham Forest on Saturday, one match wey Salah, despite scoring five times dis season, still no fit give goal or assist. Rooney yarn for […]

todayNovember 24, 2025 10

Sports

Chelsea Pay £25,000 Fine After Six Cards For Wahala Match With Man United

Chelsea Don Collect £25,000 Fine After Six Yellow Cards and One Red for 2-1 Loss to Man United for Old Trafford. Chelsea don chop £25,000 fine from Football Association after plenty yellow cards and one red scatter dia 2-1 loss to Manchester United for Old Trafford last weekend. Di match wey hot well-well see Chelsea goalkeeper Robert Sanchez collect red card just five minutes after kick-off, wey set di tone […]

todaySeptember 25, 2025 43 2

Sports

“Di Fixture Schedule No Fair To Man City” – Silva Yarn

Manchester City midfielder Bernardo Silva talk say him team dey for disadvantage against Arsenal because of how Premier League take arrange di fixtures. Gabriel Martinelli score for added time to give Arsenal 1-1 draw for Emirates Stadium on Sunday. City get 66 hours to prepare for di match after dem 2-0 home win against Napoli for Champions League on Thursday. Arsenal win 2-0 against Athletic Club for Bilbao on Tuesday. […]

todaySeptember 22, 2025 38

Sports

“Postecoglou Don Bounce Nuno, Na Him Be New Oga For Forest Now!”

Ange Postecoglou don land head coach job for Nottingham Forest, to take over from Nuno Espirito Santo wey dem just sack. Nuno waka comot from City Ground late Monday night after 21 months for di seat and na just three matches dem don play for di new season. Postecoglou dey bounce back into coaching three months after Tottenham show am red card, as dem perform anyhow for Premier League, finish […]

todaySeptember 9, 2025 35

Sports

Transfer Story: Fulham Seal Loan Deal For Chukwueze

English Premier League club Fulham FC don secure the signing of Super Eagles winger, Samuel Chukwueze, on top loan from AC Milan. Chukwueze, wey waka go join Serie A big club AC Milan for summer of 2024, no too fit secure regular starting shirt for San Siro. As transfer deadline reach, Fulham rush go complete the deal wey still carry option to turn am to permanent move. Fulham announce say, […]

todaySeptember 2, 2025 21

Sports

Transfer Story: Super Eagles striker Uche Don Join Crystal Palace On Loan

Premier League club Crystal Palace don secure the signing of Nigerian international Christantus Uche on top season-long loan from La Liga club Getafe. The 22-year-old forward, wey go wear jersey No. 12 for Crystal Palace, land for South London after him show impressive form for Spain last season. Uche play 38 matches for all competitions for Getafe, score four goals and provide seven assists. Uche football journey for Europe start […]

todaySeptember 2, 2025 104

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds