VICTOR OSIMHEN

10 Results / Page 1 of 2

Background

Sports

Why Galatasaray Dey Struggle To Pay Osimhen And Im Team Mates

By: Esther Ayoola Reports say Galatasaray dey struggle to pay players salary for Turkey, including Nigerian striker Victor Osimhen, because of dia high wage bill. According to Turkish newspaper, say Some players never collect dia salary for di past two to three months. Afta dem beat Juventus 5–2 for home last week, Galatasaray lose 2–0 away to Konyaspor, and dis don make pipo dey touch light dia frequency. Osimhen, wey […]

todayFebruary 24, 2026 5

Sports

Spalletti Rake For Newspaper Say Juventus Go Block Osimhen Progress

By: Esther Ayoola Juventus coach Luciano Spalletti, wey be Victor Osimhen former coachie for Napoli  say, im  believe im boys to  stop Victor Osimhen Galatasaray for Champions League. Di two teams go play first leg for RAMs Park on Tuesday night. Osimhen don score six goals for six Champions League games dis season. However, Spalletti say, if Juventus must progress, e dey importankpa for dem to stop Gala deadly stikers […]

todayFebruary 17, 2026 7 2

Sports

Peseiro Insist Say Lookman Na Di Same Level E Dey With Osimhen For Super Eagles

By: Esther Ayoola Former Naija coach José Peseiro say, Ademola Lookman don dey match Victor Osimhen for Super Eagles doings. Di former coachie di narrate dis to tori pipo on Thursday. Peseiro say Lookman don show say, e fit be di main man for Atlético Madrid too. E mention say Lookman don score plenti goals for AFCON and even carry Atalanta win Europa League final with hat-trick, derefore say na […]

todayFebruary 13, 2026 16

Sports

Victor Osimhen Hit 200 Career Goals

By: Esther Ayoola Na historic weekend for Naija football, as Victor Osimhen score im 200th career goal on Sunday helping im club to collobi betterlicious 4 kondo victory over Kayserispor. Di Galatasaray striker score di second goal as dem beat Kayserispor for Turkish Super Lig. So far, Osimhen don play 336 games, score 200 goals, and give 51 assists for club and country. And majority of di goals come for […]

todayFebruary 2, 2026 7

Sports

Osimhen Dey Call Lookman, Onyedika Make Dem Join Am For Galatasaray

By: Rilwan Agbomeji Galatasaray and Super eagles Striker, Victor Osimhen don yarn say e dey try make im Super Eagles padi, Ademola Lookman and Raphael Onyedika, join am for Galatasaray. Di Naija striker talk dis afta Galatasaray draw 1-1 with Atletico Madrid for UEFA Champions League match wey happen on Tuesday night for Rams Park. Osimhen yarn say e dey work actively to bring Onyedika and Lookman enter im team, […]

todayJanuary 22, 2026 20 2

Sports

Victor Osimhen Collobi Turkey Sportsman Of The Year Award

By: Alice Iduh Galatasaray striker Victor osimhen based on betterlicoius doings don win sportsman of di year award for turkey for 2025 gq türkiye men of di year awards. Di nigerian forward help galatasaray win plenty matches last season as e score 37 goals and give 7 assists across all competitions. Osimhen wey dey 26 years old, don still dey fire this season with 11 goals in 14 games.

todayDecember 11, 2025 17

Sports

I No Dey Hide, I Dey Fight Harder – Osimhen

Super Eagles striker Victor Osimhen don talk how pressure and big moments take shape im performance for di extra-time heroics against Gabon on November 13, 2025, wey im brace carry Nigeria enter di inter-confederation playoffs. For post-match interview after di dramatic 4-1 win, Osimhen yarn how e dey handle heavy scrutiny, especially after e miss two late chances for regulation time, moments wey fit shake plenty players. E yarn say, […]

todayNovember 14, 2025 31

Sports

Osimhen Burst Turkish Champs Waka, Carry Dem Go Back-To-Back UCL Win

Victor Osimhen brace help Galatasaray carry 3-1 win comot Bodø/Glimt for UEFA Champions League on Wednesday, as Turkish champions record back-to-back European win after dem no fit win before for 18 main-draw matches. RamsPark stadium crowd burst gidigba when Mario Lemina slide ball give Osimhen, wey sharply finish beat goalkeeper Nikita Haikin just 3 minutes after game start. Osimhen pressure continue as e head two crosses from Leroy Sané, but […]

todayOctober 23, 2025 20

Sports

Osimhen Go Show For Gala UCL Opener

Galatasaray striker Victor Osimhen dey set to make him return for Champions League next week after dem fear say him injury fit keep am out for long, but the fear don calm down now and e don bring relief for the Turkish champions. According to Kemerburgaz, Osimhen no go follow play the league match wey dem get away to Eyüpspor so dem no go risk am, as dem dey prepare […]

todaySeptember 12, 2025 24

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app