VICTOR OSIMHEN

5 Results / Page 1 of 1

Background

Sports

Victor Osimhen Collobi Turkey Sportsman Of The Year Award

By: Alice Iduh Galatasaray striker Victor osimhen based on betterlicoius doings don win sportsman of di year award for turkey for 2025 gq türkiye men of di year awards. Di nigerian forward help galatasaray win plenty matches last season as e score 37 goals and give 7 assists across all competitions. Osimhen wey dey 26 years old, don still dey fire this season with 11 goals in 14 games.

todayDecember 11, 2025 14

Sports

I No Dey Hide, I Dey Fight Harder – Osimhen

Super Eagles striker Victor Osimhen don talk how pressure and big moments take shape im performance for di extra-time heroics against Gabon on November 13, 2025, wey im brace carry Nigeria enter di inter-confederation playoffs. For post-match interview after di dramatic 4-1 win, Osimhen yarn how e dey handle heavy scrutiny, especially after e miss two late chances for regulation time, moments wey fit shake plenty players. E yarn say, […]

todayNovember 14, 2025 21

Sports

Osimhen Burst Turkish Champs Waka, Carry Dem Go Back-To-Back UCL Win

Victor Osimhen brace help Galatasaray carry 3-1 win comot Bodø/Glimt for UEFA Champions League on Wednesday, as Turkish champions record back-to-back European win after dem no fit win before for 18 main-draw matches. RamsPark stadium crowd burst gidigba when Mario Lemina slide ball give Osimhen, wey sharply finish beat goalkeeper Nikita Haikin just 3 minutes after game start. Osimhen pressure continue as e head two crosses from Leroy Sané, but […]

todayOctober 23, 2025 15

Sports

Osimhen Go Show For Gala UCL Opener

Galatasaray striker Victor Osimhen dey set to make him return for Champions League next week after dem fear say him injury fit keep am out for long, but the fear don calm down now and e don bring relief for the Turkish champions. According to Kemerburgaz, Osimhen no go follow play the league match wey dem get away to Eyüpspor so dem no go risk am, as dem dey prepare […]

todaySeptember 12, 2025 21

Sports

Galatasaray Don Yan Say Osimhen Ankle Bend For Nigeria-Rwanda Match”

Osimhen, wey be former Napoli striker, comot for pitch for di 35th minute after one gbege wey make am dey limp for inside Godswill Akpabio Stadium. Na Cyriel Dessers replace am, and medical people sharply rush come to make sure say di injury no go worse. After di match, Galatasaray arrange private jet make Osimhen fly go Istanbul back, while di Nigerian national team waka go Bloemfontein to face South […]

todaySeptember 10, 2025 41

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app