Business

Tins Wey You Need Sabi About Di Naija New Tax Law

todayJanuary 5, 2026 15 14

Background
share close

By Ebi Oboko

TO WHO E CONCERN – MAKE I JUST GIVE YOU DIS INFORMATE.
QUESTIONS & ANSWERS ON DI NEW NIGERIA TAX LAW
(Focus on Individuals and Small Businesses)

🟒 Q1:
When DiΒ  new Nigeria Tax Act go start work?
A1:
DiΒ  new tax law go start from 1st January 2026.

🟒 Q2:
Who dis tax law concern?
A2:
E concern everybody wey dey earn money for Nigeria – workers, content creators, remote workers, influencers, traders, etc.
Even Nigerians wey dey earn money abroad go pay tax if dem still be tax residents for Nigeria.

🟒 Q3:
Dem go tax money wey enter my bank account?
A3:
NO. Transfer, POS, deposit or withdrawal no be taxable.
Na income wey you earn dem dey tax.

🟒 Q4:
Money wey I keep for bank go dey taxed from 2026?
A4:
NO. Just keeping money for account no be tax mata.
Only income like salary, business profit or interest fit be taxed.

🟒 Q5:
I be student and I no get work, I go pay tax?
A5:
NO. If you no get taxable income, you no go pay tax.

🟒 Q6:
Tax pipo go dey monitor business bank accounts more?
A6:
YES. Dem go fit track compliance beta.
But dem no go tax your bank balance – na profit and income dem dey tax.

🟒 Q7:
Loan wey I borrow from Fairmoney or any lender go dey taxed?
A7:
NO. Loan no be income, so no tax on am.
But di interest wey lender earn, tax go enter for their own side.

🟒 Q8:
I run one-man business. Which tax I go pay?
A8:
If na business name (enterprise) – you go pay Personal Income Tax.
If na limited liability company – you go pay Company Income Tax.

🟒 Q9:
If I sell shares and make profit, dem go tax am?
A9:
NO, as long as:
β€’ Value of shares no pass ₦150 million, and
β€’ Gain no pass ₦10 million.
If e pass this limit, dem go tax the excess gain.

🟒 Q10:
I be pensioner. Dem go tax my pension?
A10:
NO. Approved pension and retirement benefits no dey taxed.

🟒 Q11:
Military salary dey taxed?
A11:
NO. Military officers salary don become tax-free.

🟒 Q12:
Creatives like musicians, authors, sports people – dem still get tax exemption on foreign income?
A12:
NO. From now on, dem go pay Nigerian tax on income wey dem earn both inside and outside Nigeria.

🟒 Q13:
Crypto profit dey taxed?
A13:
YES. Profit from crypto, NFTs and other digital assets go dey taxed.

🟒 Q14:
Who no go pay personal income tax?
A14:
β€’ People wey earn minimum wage or less, and
β€’ Anyone wey earn below ₦800,000 per year.

🟒 Q15:
Wetin be the new tax bands?
A15:
β€’ First ₦800,000 – 0%
β€’ Next ₦2.2m – 15%
β€’ Next ₦9m – 18%
β€’ Next ₦13m – 21%
β€’ Next ₦25m – 23%
β€’ Above ₦50m – 25%

🟒 Q16:
If I collect big thank u for coming package for work, dem go tax am?
A16:
If e no pass ₦50 million, NO TAX.
If e pass ₦50m, dem go tax the extra money with the new tax bands.

🟒 Q17:
Dividends or rent wey I earn abroad go dey taxed?
A17:
NO, as long as you bring the money enter Nigeria through approved banks.

🟒 Q18:
Disability pension for injured soldiers go dey taxed?
A18:
NO. Disability pension for armed forces no dey taxed at all.

🟒 Q19:
Agricultural company go pay tax?
A19:
NO. Agricultural companies get 5-year tax holiday from when dem start operation.
🟒 Q20:
Income from government bonds dey taxed?
A20:
NO. Federal and State Government bonds no dey taxed.
🟒 Q21:
WetΓ­n be rent relief for new tax law?
A21:
From 2026, you fit claim 20% of your annual rent as tax relief,
But e no go pass ₦500,000.
Example:
If your rent na ₦5m, 20% na ₦1m – but dem go only allow ₦500k.
You must declare your real rent to enjoy this relief.
🟒 Q22:
If I earn ₦6m yearly, I go benefit?
A22:
YES. Under the new law, your tax go reduce and your take-home pay go increase.
🟒 Q23:
If my company turnover no reach ₦50m, I go pay tax?
A23:
NO. Small companies with turnover below ₦50m no dey pay tax.
🟒 Q24:
I dey work remotely inside Naija for foreign company. I go pay tax?
A24:
YES, if di country wey the organisation dey exempt your salary under treaty or diplomatic rules.
🟒 Q25:
Foreigner wey dey earn salary for Naija, go pay tax?
A25:
NO, if:
β€’ Di employer be start-up, or
β€’ Dem dey tech or creative sector, and
β€’ The income don already get taxed forΒ  dia home country.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Β 

listen with your app