By: Rilwan Agbomeji
Next week, wi Presido Bola Ahmed Tinubu 65 ambassadorial nominees go siddon for front of lawmakers for grilling, to know whether dem dey qualify or not.
Three opposition senators wey yarn under cover don drop warning say dis screening no be cruise, na only people wey get brain, backbone and clean name go escape, because foreign mission work no be job for smallie dem.
For Thursday main sitting, Senate Presido Godswill Akpabio open Tinubu heavy list of 34 career diplomats plus 31 non-career names.
And e never even reach one full day afta dem start grill di first three nominees, before Jagaban drop anoda hot list for senate table like water wey no dey finish.