By: Ayobami Dada
Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don mourn veteran Nollywood actor, Olu Jacobs, wey kpai at di age of 84.
For statement wey im Special Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga, release on Wednesday, Tinubu tok say Olu Jacobs na one of Nigeria big-time actors, wey im career cover theatre, TV and movies for inside wi Obodo Nigeria and wi Obodo World.
Tinubu say di late actor hellep build and move Nigeria entertainment industry forward, while im talent, discipline and hard work inspire plenty actors and filmmakers.
Tinubu kon send im condolences to di Jacobs family, especially im wife, veteran actress Joke Silva, dia children, relatives, colleagues for di movie industry and other people for di creative space, and e pray make God give Olu Jacobs eternal rest and comfort di family wey e leave behind.