By: Esther Ayoola
Wi Oga Presido Bola Tinubu don approve make dem recruit 1,000 forest guards and arrange special rescue team afta gunmen kidnap teachers and students for Oyo State.
Na baba tuk, tuk, person, Bayo Onanuga, naim reveal dis one on Sunday afta one Federal Gornment delegation visit Esiele and Yawota communities wia dis badness sup  on May 15, 2026.
Apart from di forest guards, baba Seyi also direct one special security unit wey get beta tracking equipment make dem double transport dia efforts to rescue all di primary and secondary school pupils with dia teachers safely.