By: Ayobami Dada
Presido Bola Tinubu don order make Naija reach 95 per cent NIN enrolment coverage by December 2026, as hin tok am on the 8th National Identity Day celebration for Abuja on Wednesday.
Tinubu, wey hin Chief of Staff Femi Gbajabiamila represent, say Federal Government dey build digital infrastructure wey go help use Naija identity system drive economic growth.
Hin say gofment wan make secure national ID useful for online business, banking, welfare payments, healthcare, schools and transport services, while dem dey work on system to protect online documents, signatures and transactions.