By : Jolayemi Olajide
Wi oga Presido, Bola Tinubu don assure Nigerians say all the reforms wey im goment dey do go continue and dat im dey mout mehn to handle security, steady economy, and progress.
Inside im 2026 Eid-el-Kabir message wey comout on Tuesday before Wednesday celebration, baba Seyi salutate all Muslims for Nigeria and across di world.
Tinubu talk say true-true, im know say some areas still dey face security wahala like terrorism and banditry and dat security pipo dey try dia best.
im say goment no forget dem at all, dat with beta collabo naija go surely defeat all di jaguda boys.